Endtime Deceit
John see a revelation sey Satan go send out hin demonic spirits to operate in large-scale fo di end time period. Satan agents go say mysterious things and perform many wonders to deceive pipu. Anyone weh believes di false spirits go put him/herself to blame fo di last day. Jesus Krist warn all pipu to dey vigilant, and keep themselves pure – so that Satan no go deceive dem. John revelation write like dis: “And i see three unclean spirits like frogs dey come out of di dragon mouth, komot from di mouth of di beast, and komot from di mouth of di false prophet. Fo dem bi spirits of demons, performing signs, weh go out to di kings di earth and of di whole world, to gather dem to di battle of that great day of God Almighty. “Behold, I dey come as a thief. Blessed e bi, hin weh watch, and keeps hin garments, lest hin walk naked and dem see hin shame” (Revelation 16:13-15).
LESSON
Satan go definitely send out hin demons to deceive pipu during end time period. Di bible warns all pipu to dey vigilant, and avoid falling to Satan trap. Whoever fall to the enemy trap go suffer irreparable loss. All Satan victim go end up in hell fire! To be forewarned nah to be forearmed! All pipu must endeavor to know di true. We must effectively study di word of God, and we must not believe any teaching or prophecy weh lack bases fo di bible. Believers must dey prayerful, and we must ask God to empawa us through hin Holy Spirit to always meet God mandate.
Make disappointments no bi your portion fo di Lord Day of Judgment!
PRAYER
Dear God, i beg save my soul from di antichrist weh Satan go send to deceive di earth. Help me make i know di true; entertain di truth, and dey practice di true. Make you no let me become Satan victim, but help me to triumph and make heaven in di end of my earthly journey. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
