Do Not Take God For Granted
God vouch to send Israel and Judah nations to captivity because of dea sins. Both nations go suffer under foreign invaders, and many of dea citizens go be transported to suffer fo a distant land - fo about 70 years. Meanwhile, God promise to restore Israel and Judah back to their soil if dey repent. God state am,
‘I don make di earth, di man and di beast weh dey on di ground, by my great pawa and by my outstretch arm, and don give am to pesin weh dey proper to me. And now I don give all these lands into Nebuchadnezzar hand di king of Babylon, my servant; and di beasts weh dey field I don also give am to serve am” (Jeremiah 27:5-6)... “ Di Lord talk am: After seventy years don complete fo Babylon, I go visit you and perform my good word toward you, and cause you to return to this place” (Jeremiah 27:5-6).
LESSON:
E be more or less a suicide mission fo anyone to attempt to take God fo granted. God don clear understanding of all matter and He get strong kapability to do whatever He desire. God get pawa to give anything, and He get pawa to take anything away! Therefore, we humans must understand sey we no fit play God, neither we fit usurp Hin pawa. Hin be di Father of kreation, and whatever Hin say nah di final. Hence, humanity ought to tremble before God, and follow Hin instructions karefully. He go prosper us if we obey Am, but He go punish us if we disobey Hin rules.
PRAYER:
Dear God, i beg give me grace to serve you with fear and trembling. Make you no let me take you fo granted, so that i no go dey punish. Make me karefully follow your instructions, so that i fit prosper in all my ways. I beg make e be well with me as I endeavor to faithfully serve you everyday. For in Jesus Krist name i make my requests. Amen.