Di Wota Of Life
One woman wey Oga Jesus Krist meet fo di well side dey surprise to hear him dey deklare hinsef as di living wota! As di woman dey konfused, Oga Jesus explain well-well say, “Pesin wey drink from dis wota go always dey hungry fo wota. But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hungry fo wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.” (John 4:13-14).
LESSON
Oga Jesus Krist na di living wota wey come from God. Any pesin wey drink from di wota no go dey thirsty again! Di effet of Oga Jesus’ pawa pass to satisfy any physical thirst. Di Savior go offa foreva life to any pesin wey accept him as dea personal Lord and savior. Infact, he go bless hin believer with forever life and perfect peace fo heaven - forever! Howeva, any pesin wey no accept di salvation of Oga Jesus Krist no dey qualify to enta heaven, that pesin go get hin place fo hell fire - where life wey no dey finish sofa go dey.
PRAYER
Oga Jesus krist, I wan go heaven, I no wan go hell fire. I konfes you say you be my Lord kon accept you as my Personal Savior. As from today, I give my komplete life to you, and I promise to dey serve you fo all di days of my life. Na fo Oga Jesus Krist name i beg all dis. Amen.
