Di Trials Of Di Belivas
Jesus Krist warn Hin pikin wey dey folow am make dem no think say Kristenity na “bread and butter.” Kristenity require make any pesin drop Him pride attitude bekos sey he wan please God. Kristenity go also require sey make we deny ourselves some enjoyment and endure trials so God name go dey praised. Oga Jesus teach Hin pikin wey dey folow am sey, “Dem go drive una komot fo di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una, go tink sey e dey do God work.” (John 16:2). Moreova, Oga Jesus tell Him pikin dem wey dey folow am say He go rewod dek for evri sakrifice wey dem make fo di sake of hin kindom. Oga Jesus tok say, “Make una nor let anytin worry una mind. Since una bilive God, make una still bilive mi. Many rooms dey for my Papa house and I dey go prepare place for una to stay, if nor bi so, I for tell una. Wen I don finish, I go kom take una, so dat una go stay with mi for where I dey. And una go know di place wey I dey go and how una go take rish der.” (John 14:1-4).
LESSON
Evri pesin wey sofa for di sake of Oga Jesus Christ go get hin rewod for heaven; evrione wey endure trials and persekusans for hin sake go receive the crown wey no fit perish for heaven. Any tribulation wey any kristen face today no go be foreva, but go soon end, and make dem take am as sakrifce for di sake of gospel. God go rewod evri sakrifice and any good tin wey pesin do for hin kindom. So, He dey good make Kristen dey endure pain wey no go dey foreva, make dem kon stay kanpe in Oga Jesus, so dem go fit get beta rewods from God. On di oda hand, Oga Jesus don promise say he no go leave di bilivas during trials, he go give dem pawa through di Holy Spirit so dem go fit get victory. (John 16:13).
PRAYER
Dear Jesus Christ, please help me to remains steadfast in faith so that I can be crowned in heaven. Empower me through your Holy Spirit to be diligent and keep your testimony until the end. When the end comes, let me receive warm welcome in heaven, and let me partake in your holy banquette. Amen.
