Di Judgement Day Of Di Lord
Oga Jesus Krist talk am to all hin pipu say hin salvation offer na di only way fo any pesin to enter di kingdom of God. Oga Jesus talk say, “ “I tell una true word, di pesin wey take wetin I talk and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end. I tell una true word, di time dey come and e don even reach ground naw, wen dos wey don die go hear Man Pikin voice and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again. Bikos as di Papa get life fo inside am, na so e give en pikin life too.” (John 5:24-26).
LESSON
Di Lord Day of Judgment go come fo all pipu to see. Both dose wey don die and dose wey still dey life go face di judicial panel of Oga God; di kreator go send di sinas wey no repent to hell fire, but he go send di sinas wey repent to heaven. Di pipu wey dem class as sinas wey don repent be dose wey don repent from dea sins and also don accept Oga Jesus Krist as dea personal Lord and savior. Sinas wey no repent be di pipu (dead or alive) wey refuse to deklare Oga Jesus Krist Oga Jesus Krist as di Son of God, no kon accept am as dea savior.
PRAYER
Oga Jesus Krist, I no wan go to hell fire, but I won go to heaven. Now, I konfes say you bi di son of God wey die fo di sin of di whole world. I accept you Oga Jesus Krist as my personal Lord and savior; I repent from my sins, and I go faithfully serve you from now on,and fo all di days of my life. Kon help me Oga God! Amen.
