Di Holy Spirit Help Us Too Please Oga God
Di Spirit of God det tok to us thru di skriptures. He talk say, “I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont.” (Galatians 5:16). Some lusts of flesh wey wey we most stop dey mentioned. “Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol; to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol; bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!” (Galatians 5:19-21).
LESSON
Kristenity no be about “bird of roses,” but it requires say make we deny oursef to aktivities wey dey vex Oga God. So, as shidren of God, we most to dey fight against wetin di flesh want. God will konpesate us wit hin blessin if we glorify him in our flesh. We most to allow di Spirit of Oga God to rule in our lives. Works of di Holy Spirit dey bring good fruits, and dese fruits dey mentioned to is in di skripture. “But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes, gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins.” (Galatians 5:22-23).
PRAYER
Oga God, abeg let yur Holy Spirit dey rule for my heart and let him dey help me to dey do aktivities wey go give me yur blessin. Stop all works of flesh in my life, and let yur divine Spirit dey give me strength to bring good fruits wey go lead to yur kindom. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
