Dey prepared
Oga Jesus krist ask hin pikin wey dey folow am to dey jejely wait fo hin second comin, he talk say; "Savant wey en oga go come back kon meet am dey work, make e happy well-well bikos di oga go prepare ensef make e fo serve di savant food fo tabol. Make doz savant happy well-well, even if di oga kom fo nine or three oklok fo nite kon si sey dem neva sleep. But make una know sey, if di owner of di house know wen tif dey kom, e nor go let di tif break enter en house. Una must dey ready too, bikos Man Pikin go come wen nobody dey espect am.” (Luke 12:37-40).
LESSON
Evri Kristen most to dey kanpe, kon dey wait fo di second comin of oga Jesus krist. if dem still dey kanpe, oga Jesus krist go carry dem go hin fada kindom. Belivas wey dey kanpe in dea faith and wey dey keep di testimony of oga Jesus krist go bin known as "Just" fo di last day and dem go get dea reward say dek dea faithful. oga Jesus krist go carry hin pipu home and hin go wipe komot dea tears of di sofa wey dem get komot fo dier face. oga Jesus go give dem hin crown wey no fit perish to di saints, kon grant dem permanent access to hin fada kindom. Belivas must to dey kanpe and kip dea testimonies to di end becos plenti rewards do dey fo dem.
PRAYER
Oga Jesus krist, abeg give me grace so i go stay kanpe wit you, so i go fit receive plenti rewards from you fo heaven. Kon help mi to dey watch and wait fo you till you come back to eart to carry your saints, kon help mi so i go dey among dose you go come carry and make my name dey fo di book of life. Wen i don finish fo dis eart, i wan meet you from heaven so i go sing hosanna wey bi your song, i know say you go ansa my prayers and i tank you oga Jesus krist fo di grace you use safe me. AMEN
