Celebrate una Right In krist
Oga Jesus krist sent some 70 of his pikin wey dey folow am make dem go preach di gospel and he tell dem Hin pikin wey dey folow am use di power wey hin give dem dey enjoy well-well.
LESSON
Belivas of oga Jesus krist get devine power wey dem go fit get big testimony to di glori of God. Since Kristen don receive krist promise to dey prospa in all dier ways,them go dey dey loose and bind anytym and fo eni situation. Meanwhile, di tin wey dey important fo Kristenity bi say dem get di power to preach di gospel to evri wea fo dis eart. Satan no fit stop di Kristen but dey go dey operate through di holy spirit to talk about oga Jesus krist fo evri wea. Unbelivas go kon to di marvelous lite of oga Jesus krist and dey safe. So, all Kristen must to dey celebrate dea rights and privilege in di Lord. We (belivas) must go out to show God power wey dey inside us to gain profit fo his kindom.
PRAYER
Oga Jesus krist,i dey hapi to have belive and accept you as my personal savior! Since,i don belong to you,all rights and privilege na hin you don give me so i dey prosper; therefore,i dey ask fo your strength to come out fast fast! Kon give me power so i go fit use my right and priviledges as a Kristen to komot di kindom of darkness and talk your goodness to evri wea fo eart. Let your holy spirit give me power and strength so i go fit talk your gospel well,let your signs and wondas dey wit my ministries so di unbelivas go fit see and know say God dey good! Thank you Oga Jesus krist bekos i know say u go do more dan i ask from you.Amen!
