Believer Must To Dey Avoid Wicked Pip
Di Pharisees and Sadducees surround oga Jesus krist like bees wey dey find chance to
bite dea host. The religion enemies set traps and tested oga Jesus many times wit di hope say he go fall wit wetin he dey talk, so dem go fit arrest and kill am. But, Oga Jesus get sense to know wen hin enemis don dey around, and he dey put dem fo di right place! Wen di pharisees ask am one question wey no dey simple to ansa about resurrection, oga Jesus send dem make dem go sheck a skripture wey everybody fo di society respect - and hin emenis dey silent (Luke 20:27-39). Howeva, oga Jesus krist warn hin pikin wey dey folow am to dey watchful fo di mago-mago pipu wey go dey envy dea success and go want make dem fall. Oga Jesus talk say, "Make una guide unasef from di law tishas. Dem like to dey waka wit long klot make pipu dey shaut dea name fo market and chairs wey betta pass fo sinagog, na dea dem dey like to sidan. Dem dey sofa women wey dea husband don die and kollect dea tins kon dey pray long prayer make pipu fo si dem. So na dea ponishment go big pass.” (Luke 20:46-47).
LESSON
We kristen bi God pikin and we bi di light wey dey surrounded by pipu wey dey enjoyi fo darkness; so we must to dey kareful! Our works and di way wey we dey do dey vex do worldly pipul. We must get sense so dose wey dey do evil no go carry us to dea evil place. Make we no sin to God bekos say we want make di world accept us. We kristen must dey live go di godly life wey we dey live so we no go lose heaven.
God go give us di pawa wey we go use ovacome anitin wey we go face, and he go rewod us fo everything wey we do well.
PRAYER
God abeg, help mi make i dey wise and get sense so di wicked pipu no go catch mi. Kon help mi so i no go fit folow dose wey go make mi sin against you. Kon give mi pawa so i go dey kanpe in faith, and make mi keep my godly testimony to di end so i go dey blessed well-well fo heaven. Na fo Oga Jesus krist name i beg all. Amen.
