Believer Must Seek God Thru Prayers
King David find hinsef fo trouble, and he kry to God say make he help am. Di king dey sure sey God go answer hin prayer and deliver am from di trouble wey he dey. David prayer dey written, “My God, You go forget mi forever? Na how long You go trowey your face from mi? How long I go dey struggle with pain inside my soul and get sorrow fo my heart? Na how long my enemies go always dey opress me? My Oga God, make You turn come answer me! Make you give me strength again or I go die. Make You nor let my enemies dey make mout sey, “Wi don win am!” Den dem go dey happy sey I don fall.” (Psalm 13:1-4).
LESSON
Kristen no get beta weapons pass prayer We dey enkorage to call on God and put our request fo hin front every time. Limit no dey to di number of requests wey we fit ask God. He get enough pawa to handle many situation at di same time, and he go surely respond to di need of hin children. So, with understanding, sey christian no be pesin wey no get papa and mama or no get power, we must to dey walk to our father wey dey heaven kon ask fo anything weh want from him. Oga God response to prayer inklude, but no dey limited to protection, provision, and promotion.
PRAYER
Dear God, I understand sey you be di King of di eart; you get everything fo hand, and nothing dey difficult fo you to do. Now, I calll your presence come my situation, and I dey ask fo your help. Abeg, finish every mountain of challenge wey dey around me. Level mountain of sickness, poverty, and all form of attack. Come give viktory and laughter. Let me dey rejoice and joli fo your goodness in di land of di living. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
