As kristians wey we bi, di power wey we go fit dey do as oga Jesus krist dey inside us
Moses wey bi di servant of God finish hin work wit di Israelites na so hin tell dem bye-bye. He kon talk and pray fo di pipu so dem go fit joli fo di land wey God tell dem. Moses bin call dem as their tribes and talk en blessings on dem, he kon say, “Reuben tribe go live and dem nor go die, even doh dem nor plenty.” Moses pray for Judah tribe sey: “My God, make You hear Judah pipu kry kon bring dem togeda as one. Make you give dem power to take fight and win dea enemies!” Moses pray fo Levi tribe sey: “My God, you don give your Tumin and Urim to doz wey dey fear and respet you. Dos wey you don test for Massah kon follow dem kworel for Meribah wotaside. Dem tell dea papa and mama sey, ‘Wi neva si am’ and e nor do like sey e know us or en own shidren, bikos dem keep your word kon guide your kovenant. Dem go tish Jakob your law kon tish Israel pipu your kommand, dem go offa betta incense fo you kon burn good ofrin fo your altar. Make we bless God strent and di work wey e don do; bikos e kill di enemies lion, so dat dem nor go fit raiz at-all!” Moses pray fo Benjamin tribe sey: “God love Benjamin pipu and dem dey safe under am. E dey gada dem from every side,so dat nortin go do dem.” Moses pray fo Josef tribe sey: “Make God bless una land wit rain and wit wota wey dey kom from under ground. Make betta-betta fruit wey dey grow under di sun dey una land and di fruit fo di sizin go bi una own, make betta fruits kover una hills and mountins,make good tin full una land and na God goodness go bless dem, bikos na-im talk from di bush wey dey burn.
Make dis blessing kom meet Josef tribe, bikos na-im bi leader among en brodas.
LESSON
Na good tin for ani pesin make him dey kampe wit God, make hin con serve am well-well, because eni pesin wey do am get plenty joli wey him go get and hin go pass am to hin pikin pikin. As he dey to every pesin, bad tin fit happen wey do wan bring tin to di life of God chidren, but God wey no dey do mago-mago no go allow bad tin happen to him pikin, any tin wey later happen (na good or bad) go later koprate fo di plan wey God get fo hin chidren.
Pipu wey dey serve God make dem kontinu because dea joy go plenty. Dose wey never start to serve God must do am because say dem no go throway anitin if dem serve God but dem go gain every good tin wey dem need.
PRAYER
God abeg, i no say you dey care for pipu wey serve you. You no go let dem down wen wahala come, but you go dey make dem joli. True true, you dey watch on your chidren so the good tin wey you get fo dem go show for dea life. I con swear say i go dey serve you from today,i go serve you wit my paws and i go dey do so till i die. Wetin i want now na grace so i go fit keep my promises. Abeg make my faith dey kampe so i go dey enjoy you fo my life, make my face shine, make your good tin no comot fo my mouth fo ever. Na in the name of oga Jesus krist i beg all dis. AMEN.
