You nid no pesin approval to accept oga Jesus
Oga Jesus krist talk am di part wey hard pass fo Kristenity to hin pikin wey dey folow am, he talk say;
"If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple. 27 Anybody wey nor gri karry en kross follow mi, nor fit bi my disciple".(Luke 14-26-27).
LESSON
Salvation dey personal and pesin no fit get am by say make anoda pesin help am. Nobody must to dey wait fo anoda pesin approval before he/she turn to oga Jesus krist. God talk say make evryone on dis eart accept oga Jesus krist as hin personal Lord and savior. Eni one wey belive dat oga Jesus krist na di son of God go dey safe, but eni one wey no accept di lordship of oga Jesus krist go enta hell fire"Anybody wey bilive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor bilive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor bilive God Pikin name".(John 3:18).
PRAYER
I ondastand say salvation dey personal, now i konfes my faith in oga Jesus krist. I accept am as my personal Lord and savior, and i go serve am fo di days of my life. I also konfes my sin and i don repent from dem and i kon ask God make hin give me di pawa so i go dey faithful to him fo di rest of my life. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen
