No dey make empty promise before God
Judge Jephthah find hinsef fo a situation wey hard bekos of di vow wey hin make to God. He promise say he go offer God sumtin wey important to am if God help am to win hin enemis. Jephthah talk say;
"anytin wey go first kom out from my house kom welkom mi, I go sakrifice am as burn ofrin give You.”(Judges 11:31). God ansa Jephthah preya but na hin only dota kon welkome him fo hin domot which mean say he go offer her as a sacrifice to God (please note; this kain sacrifice no dey useful fo this world we dey again!).The skripture talk say;
"Wen Jeftah rish en house fo Mizpa, en only pikin wey e get fo en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin wit happiness. Wen e si am, e vex kon tear en klot. E kry kon shaut, “Oh my dota! You don distroy mi! You don kause wahala fo mi! I don make vow give God and i nor go fit take am back.”Naim di girl sey,Papa, if you make vow give God, den you must do wetin you vow, bikos na God give you viktory ova your enemies, Ammon pipu. But first allow mi go do dis one tin: Allow mi go on-top di hill go roll and kry wit my friends fo two mont first, bikos i go die as virgin.”(Judges 11:34-36).But Jephthah do wetin he promised God even say di tin big, he honor God and give am hin only dota.
LESSON
We sopos to dey respect God evritym. we must to dey respect am, we must dey kip our promise to him, we must no dey quick to promise am. we must dey careful not to make promise wey we no go fit do wen we dey hin presence.
We must dey check our words bekos say God no dey allow joke!. He go make sure say we do anitin wey we promise am.He go dey ask of am ontil we do wetin we promise am. Therefore, we must to dey kareful so we no go make empty promise to God. God go bless anyone wey do wetin he promise am and go make sure say pesin dey enjoy well-well so hin go fit dey make promises to am.
PRAYER
God abeg, kon help me so i go dey respect you in wetin i dey say and wetin i dey do. Kon make mi fulfill my promises to you. let di promise wey i dey fulfil to you open new doors of opportunity fo my life, kon let mi dey enjoy your goodness fo di land of di living. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen
