No go abuse God's grace
God promised say hin go bless manoah's family wit a nazirite shaid wey go deliva Israelites from dia oppressions. Di angel of God tok am to manoah's wife say;
"Afta yu don born am, make yu nor ever kut en hair, bikos from di day wey dem born am, dem go dedikate am give God of Nazirite. E go safe Israel pipu from Filistia pipu hand.”(Judges 13:5). Them born di shaid and dey name am Samson. He kon become judge in Israel and God give am pawa wey plenti well-well. He kill lion wit hin hand, and he kill some 1000 enemis wit ordinary jawbone wey bi fo donkey. wen he won drink wota afta a battle, Samson pray to God say make he give am wota and God ansa am kia-kia. Jehovah kon use earthquake shift eart formation and wota come out fo Samson to drink so he go dey thirsty again.
LESSON
As God dey so, wondas no go ever end!. he go dey perfom hin wondas through hin anointed savants, and he go see say his name dey praised fo di world. God savants must to ondastand say God no selet dek bekos say dem holy. God wey call dem get hin own special reasons fo any talent or grace wey hin give pesin. Therefore, all savants of God must dey humble and dey careful so dem no go abuse hin grace and talents.
PRAYER
God abeg, no let your wondas stop fo my life, make i receive your grace so i go dey selected fo special assignments wey go glorify your name fo di whole world. once i dey anointed, abeg kip mi humble so you go fit use mi well-well, so your name go fit bi glorified more dan ever before. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen
