God no dey selet
Oga Jesus krist tel di Pharisees make dem shun dea religious belief, make dem become konfam shidren of God. while di Pharisees folow oga Jesus fight say hin dey preach di gospel to di sinners, di messiah korreted dem as he explain to dem well-well, he say;
If you get hundred sheep and one lost, you nor go leave di ninty-nine wey remain go find dat one till you si am? Den wen you si am, you go karry am fo shoulder, dey happy. Wen you rish house, you go koll your friends and neighbours sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos i don see my sheep wey lost before.’ I tell una true word, na so happiness dey fo heaven wen one sina turn from sin kom meet God, pass ninty-nine good pipu wey don already dey with God.(Luke 15:4-7).
LESSON
Man fit dey selet, but God no dey selet. di kreator loves all pipu di same way and he open hin hand wide to receive and change sinners so dem go come to hin kindom. Di heavenly fada dey always hapi to see a sinner wey repent from hin sin. Infact, di scripture talk say all angel dey joli ova a sinner who komot fo sin kon turn to oga Jesus krist. (Luke 15:7,10).
PRAYER
Lord Jesus krist, abeg safe di unbelivas make dem know and accept say you bi di son of God wey die fo dea sins and make dem give dea lives to you, let dem accept you as dea personal Lord and savior so they go fit prospa on eart and fo heaven. I also pray say make you destroy all Satan work in belivas lives so dey go dey focus on you to di end. wen di end comes, let all your saints bi welcome to heaven so dem fit joli fo your presence foreva. Amen
