Reject Traditions Wey Dey Against God Law
Di church wey dey jerusalem make one judgment call on whether to free non Jewish believers from Jewish traditions. Dey talk am say he dey compulsory fo brothers to serve God in di liberty of dea spirit – witout say dem give chance fo human tradition wey fit stop di gospel expantion. Church elders write Paul say, “But fo Gentile pipu wey don believe, we don write letter go give dem sey, make dem forbid meat wey dem sacrifice give juju; animal wey dem kill and e blood nor touch ground and make dem nor sleep with who dem nor marry.” (Acts 21:25).
LESSON
Many polls show say that non-Jewish christian plenty pass di jewish christian. On di oda hand, whether dem born a christian a jewish or not, we must obey God law; we must engage in a praiseworthy activities – we glorify God name. Even say traditions fit challenge us to moral behaviors, but make we no mistake am fo di law of God. Human tradition no be di law of God! So, we must to study di bible to understand wetin God want. Our success fit stay with us only if we know di truth kon dey do am. God go forever glorify hin name in di lives of pipu wey follow am with respect.
PRAYER
Oga God, I don learn say human tradition dey different from God standard of holiness. Now, I ask say make you safe me from any tradition wey fit dey kourse problem to my standard of holiness. Help me to komit myself to dey study di bible so I go fit live di life wey I suppose dey live. Abeg safe my soul from sin so I no go dey disappointed on di last day. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
