Believers Must To Dey Love
Di bible raise sure hope fo believers; we assured say all this problem wey dey happen fo di world go soon end fo God saint, and we go be with di Lord forever. He dey written say, “God go judge many pipu kon settle di worry wey strong nations get. Den dem go dey use dea sword and spears take dey work fo farm. Pipu from different country nor go fight each oda again or train dea pipu to go fight war. Everybody go stay fo peace and dem go prosper. Dem go enjoy dea own grape and fig tree, bikos e nor get anything wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!” (Micah 4:3-4).
LESSON
Any sofa wey a child of God dey see no go dey forever, but go end one day. All children of God soon escape this terrible world to go dey with God fo heaven. Fo heaven, Oga Jesus Krist go be our life president, and we no go sofa again! Dea go be peace wey no get sadness inside. In fact, saints go drink from di river wey peace dey wey dey flow from di heart of Oga God Hinsef. Now, since plenti pride of victory dey wait fo di believers, all christian must to dey kanpe with God. We must to dey endure any temptation or sofa wey di enemy fit do us – since we don know say God life wey no dey finish reward dey wait fo us fo heaven.
PRAYER
Oga God, I love you pass silver and gold. I love you pass persecutions and sofa. My goal na to reach heaven at di end of my journey fo dis eart; Now, I komit my complete life to you today. I accept Oga Jesus Krist as my true Savior, and I accept am as my Lord. Abeg keep me make I dey kanpe wit you and let me serve you with all my heart fo all di days of my life, so that I go qualify to enjoy life wey no dey finish with you fo heaven. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all. Amen.
