God dey Able
The pikin wey dey folow oga Jesus krist honor him fo public. Dem sing hin praise and give arm royal entry to Jerusalem. He dey written say, “Dem take di donkey kon put dea klot on-top am, den Jesus sidan put. As Jesus dey ride dey go, pipol kon spread dia klot for road.
As e dey enter di road wey go Mount Olives, all di disciples kon dey happy, dey praiz God wit loud vois fo all di mirakles wey dem si. Den dey bring him colt (horse) to Jesus. And they tro dea own klot on di colt, and they set Jesus ontop arm. And as He go, many spread dea klot ontop d road. Den, as He kon dey draw near di descent of di Mount of Olives, all di multitude of di disciples start to dey rejoice and dey praise God wit loud voice fo all di mighty works they had seen, saying:“God don bless di king wey dey kom wit en name! Make peace dey fo heaven and make all di glory bi God own!” (Luke 19:35-38).
LESSON
No one deserve beta honor pass oga Jesus krist who leave hin joyful place fo heaven to come down to di eart fo di sake of dying fo di lost sinas. All kristen dey qualified to bi oga Jesus’ cheerleaders, and we must to sing hin praise to di ends of the eart.
PRAYER
I love you oga Jesus krist, and i dey veri proud of you! I thank you fo all di good fo my life. I specially thank you fo your divine kommitment to leave heaven and come to earth in oda to die fo di sinas. My praise no go dey komplete until I don konfes you as my Lord! Therefore, konfes wit all my heart you oga Jesus krist as my personal Lord and Savior. I give you my whole heart, and I don redi to serve you fo di rest of my life. I believe dat i don dey safe now.Thank you oga Jesus krist fo your grace weh dey safe. Amen.
