Obedience Beta Pass Sacrifice
King Saul abused hin relationship with God, and he make di same mistakes well-well. Wen he sopos to folow wetin God tok and dey blessed, Saul choose say he go do wetin he want and disobey God. One of di tin wey Saul use disobey God bi say wen he no destroy God enemis as God tel am make hin do. Wetin God tel am be say, "Den, Samuel kon tell Saul, “Na mi God send make e make yu king ova en pipol, Israel. Naw make yu listin to wetin God dey talk. Dis na wetin God wey dey heaven dey talk: ‘I see as Amalek pipu dey trobol Israel pipu, wen dem dey kom out from Egypt. So make you go kill Amalek pipu. You go distroy everything wey dem get. Nor leave anybody or anytin. Kill everybody both man, woman, yong pikin, melu, sheep, kamel and donkey.” (1 Samuel 15:1-3). On di oda hand, Saul no do wetin say make he do, he kill some enemis but leave some beta tins wey dey di land fo hin own rishis. He kon talk say he wan use wetin he carri komot fo di enemi place make sakrifce to God. Howeva, profet Samuel vex fo King Saul and he say, “Na wish one God like pass: to obey am or to offa ofrin and sakrifice?
E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am. (1 Samuel 15:22). Since Saul son fail to obey wetin God tel am, God komot am as di kin of di Israelites, and David kon later bi di King.
LESSON
“E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am. (1 Samuel 15:22). Obedience no get wetin fit replace am, We must to dey obey God everytime. We no fit tel God wetin hin go do; we must to dey do anitin wey he want make we do - and we must to dey do am well-well. Anitym we dey talk about God "We must to dey obey before komplain". On di oda hand,God go bless any pikin wey dey folow am. He go honor any pesin wey obey am! God fit do anything to bless and honor any pesin wey choose to fear and obey am. So, all pipu must to dey obey anything God say since dem no fit regret if dem obey am.
PRAYER
Oga God, I ondastand say you don talk am say all pipu must to faithfully obey you and folow anything wey you talk. Now, i don redi to give my life and obey you well-well. I go serve you and honor you as long as i dey live. I dey use dis opportunity to ask fo your extra grace wey go make mi satisfy you everitym. Abeg give mi your grace so i go fit prospa on eart and fo heaven. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
