Oga Jesus krist na di way to heaven
Di religious scholars and Pharisees dey jealous of oga Jesus krist bikos he get different way wey he dey use preach, and kon dey find how dem go harass,punish and kill am.
The mago-mago pipu question hin on some topics - wey bi tax payments. On di oda hand, oga Jesus - di son of God dey kanpe and he dey always give dem konfam ansa to dea question. Some of the time wey Jesus don ansa dem dey down fo here:
1. "One day wen Jesus dey tish pipu fo di temple, di priest oga dem and di law tishas kon meet am, dey sey, “Make you tel us, na wish pawa you take dey do dis tins? Na who give you di pawa sef?” Jesus ansa dem, “Make i still ask una one kweshon and make una ansa mi. John baptizim kom from heaven, abi na from pipu?”
Dem kon dey talk wit each oda sey, “If wi sey na from heaven, e go sey, ‘Den why una nor bilive am?’ But if wi sey, ‘Na from pipu’, dis pipu go stone us, bikos dem bilive sey, John na profet.” So dem kon tel Jesus sey dem nor know wea di baptizim from kom. Den Jesus tel dem, “Mi too nor go tel una who give mi di pawa to do all dis tins.” (Luke 20:1-8)
2. “Den di Farisee pipu and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipu go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor. So dem ask am, “Tisha, wi know sey wetin you dey talk korrect and you nor dey do wayo, bikos you dey tish di trut about God. Make you tel us, ‘E good make wi pay tax give Caesar?’ ” But Jesus know sey na trap, so e kon tell dem, “Make una show mi di money. Wish pesin face and name dey?” Dem ansa, “Na Caesar own.” So Jesus tel dem, “Den make una give Caesar wetin bi Caesar own and make una give God wetin bi God own.” So dem nor fit get am wit en word fo di pipu present. Dem sopraiz fo di ansa wey e give and dem nor fit talk again. (Luke 20:20-26)
LESSON
Any pesin wey wan challenge di authority of oga Jesus krist just dey joke nii. No pesin fit challenge him authority! Pipu who dey think say dem wise and pipu wey think say dem fit get salvation from anoda place make dem think am twice and make dem know say no deity or pesin don die kon wake up again - na only oga Jesus krist. At least, kommon sense talk say if oga Jesus krist fit wake up afta he don die before,he go kip di pawa wey hin go use wake hin pikin wey dey folow am from death fo di last day. Wetin we dey talk bi say, oga Jesus krist na di only way to get life wey no dey finish. So, all pipu must to jejely come to oga Jesus krist, kon accept am as dea personal Lord and savior.
Any bodi wey no accept oga Jesus krist no go wake up from di dead to share a part for God's kindom.
PRAYER
Yes, I believe say oga Jesus krist na di only way to heaven! Yes, yes, yes, i dey redi to give my life to oga Jesus krist today! I dey deklare and i dey swear to God say (Mention your name) deklare say oga Jesus krist na di son of God wey die fo sinas. I believe say oga Jesus krist na di only way to di kindom of God; Now, i konfes him (oga Jesus krist) as my personal Lord and savior. As from today, i bi pikin of God, and i go serve God foreva! Amen.
