Usin Di Authority Wey Dey God Name
Goliath led di Philistine army harass di Israelites fo forty days. No Israelites fit face Golaith bekos of di stature wey hin get and say he sabi fight. Goliath being huge in stature and very skilled a warrior, di pipu weh dey Israel no confront. Di gentile soja cursed di Israelites and koll dea God evil, and no Israelite soja get konfidens to face am, including King Saul.
On di oda hand, a young boy (wey no dey ripe to bi a soja) wey hin name bi David get di kourage to face Golaith and fight am. David wan silence di unbeliever wey rubbish God and hin army. Di boy talk say, “Na wetin dem go do fo di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?” (1 Samuel 17:26). Howeva, Goliath abuse David kon curse him by hin god. David only talk few words before di battle start and hin response bi, “You dey kom meet mi wit swod, spear and javelin. But i dey kom meet you wit di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey you dey shalenge." (1 Samuel 17:45).
LESSON
Goliath bi di Satan wey harass di Israelites fo forty days, ontil God give David di pawa to silence am patapata (1 Samuel 17:26). Satan still get many Goliaths wey he dey use harass God pikin today, and dey must dey silenced also! Di same way wey David use to silence di first Golaith shud also bi used to silence any oda wey face any kristen. Wetin Kristen go use use face dis generation of Goliath no bi sumtin we fit see wit our koro-koro eyes, but dey must dey spiritual. Believer must to dey use preya to stop satan from hin effort. Even though he fit face dem many time, dey go no work wit di preya of faith! Believers must ondastand say Satan no get pawa ova preyas - God get am! Di enemi go run wen kristen mention di name of Oga Jesus krist fo dea preyas. So, all God pikin must perform dea faith and use dea pawa wey God give dem to ovacome Satan. Fo example:
1. Pesin wey get marital challenge make him say, "I komand Satan make he run komot fo my marriage in di name of Oga Jesus krist! My marriage bi institution of God, and i must to enjoy am!"
2. A person who hin health no dey kanpe make hin say, “I komand Satan make he komot hin hand from my health in Oga Jesus name! I claim good and konfam health from God, and i receive di cure to my health problems from di blood of Oga Jesus krist. I deklare healing today, tomorrow and forever - in di name of Oga Jesus krist."
3. A pesin wey no get resources make hin say, “I rebuke Satan and I command him make hin remove his dirty hands komot fo my resources! God dey rish and i dey rish also! I destroy povaty fo my life and i deklare myself a rich pesin. I claim my total victory ova poverty today and forever – in the name of Oga Jesus krist! Amen.”
PRAYER
Oga Jesus krist, abeg help mi make i use my authority wey i kip in your name. Kon give me pawa so i go ovacome all forms and appearance of Goliath in my life. Kon anoint mi wit your holy spirit so i go fit exercise my faith in a way wey go benefit your kindom, and also prospa my life. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
