Oga God Di Saviour
Oga God like to dey bless Hin pipu than to dey punish dem. He dey like to see a sina wey dey repent from dea sins and dey blessed dan to remain storbon in sin to receive life wey no dey finish punishment. Also, God wants repentans of Kristen wey don fall before; he go accept dem with Hin open arms if dey fit turn a new leaf. Fo wetin he talk to di nation of Israel, God talk say, “Una wey nor dey faithful,make una come back come meet me. I go sorry fo una and I nor go vex again! I nor go vex for una forever. But make una first gri sey una don sin against Me wey be di Oga una God. Make una confess say una nor dey obey my command and una don show una love to oda gods fo under every green tree.” Me, wey bi God, don talk. “Pipu wey nor dey faithful, make una come back kom meet Me, bikos na me get una. Among una, I go choose one pesin from each town and two pesin from each family, den bring una come back to Mount Zion.” (Jeremiah 3:12-14).
LESSON
Oga God loves humanity, and he dey redi to safe everybody. He go safe anybody wey come to him fo protecson and salvation. However, He dey painful fo di kreator to dey see say some pipu dey storbon in dea sins, and no won repent. Also, some christian wey don fall from dea faith dey cause God big pain with dea decision. Jehovah dey expect say make Hin shidren dey kanpe with am, so He go fit bless dem. So, di hand of God dey open to accept christian and oda sinas wey don fall before. He go shange dea lives kon make dem dey kanpe fo hin life wey no dey finish blessing – if dey fit return to Am.
PRAYER
Oga God, I dey sori fo all di bad tins wey I don do, and I dey redi to repent to you again. I won stop to dey hurt you with my actions; I won start to dey do anitin wey you want. I see myself as di prodigal shaid wey no obey you kon lost everything; abeg I don come back to you today. I go start to dey work in your ways and I go serve you faithfully fo di rest of my life so dat I go fit prospa in all my ways. Abeg give me grace to do so. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
