Di Lord No Go Cast You Off
Paul make a public confession about hin mistakes as a persecutor of christianity. He talk sey, “Why una think sey God nor fit raiz pipu wey don die? Even me mysef, I believe before sey make we fight Jesus Krist wey come from Nazaret. And na wetin I do fo Jerusalem be that. Nor be only sey I put many of di believers fo prison with di pawa wey di priest oga dem give me, but I even dey support wen dem sey make dem kill dem. I punish dem many times fo all di sinagog and I try to force dem make dem curse God. Bikos dat time, I dey vex fo dem well-well, I even travel go oda towns go sofa dem, bikos of wetin dem believe.” (Acts 26:8-11). However, Paul talk am well-well how he take change with Krist he say, “My king, around afternoon fo road, I kon see one kind light from heaven wey shine pass di sun. Di light shine round me and di pipu wey dey follow me travel. Wen we don fall fo ground, I hear one voice wey use Aramaik language tell mi, ‘Saul, Saul, why you dey punish me? You dey fight yoursef, bikos na stone you dey kick so.’ So I ask am, ‘Oga God! Who you be?’ God answer, ‘I be Jesus Krist wey you dey punish. 16 But make you get up, bikos I don show mysef to you and don choose you as my servant and withness to di things wey you don see and di ones wey I go show you.” (Acts 26:13-16).
LESSON
Oga Jesus Krist go accepts pipu wey turn to him fo salvason – he no go reject anybody. No mata wetin dem don do, Krist go forgive sinas wey repent; he go komot face fo di sins wey dem don komit, and he go clean dem up. Krist go give new life and new name to hin saints. Everything wey dem need to enjoy di benefit of di kingdom of God be confessions of sin,and acceptance of Oga Jesus Krist as Lord. Any pesin wey accept oga Jesus Krist as hin Lord and personal savior no go dey ashame, but go get di gift of life wey no dey finish.
PRAYER
I don dey lost fo sin before, but now I don dey safe in Oga Jesus Krist. Krist di Son of God don shange my life: He find me, forgive me of my sins, Hin safe my soul from di sofa of hell fire. My life kon shange in Oga Jesus Krist, and I don dey safe now! Praise God, my name don dey written fo di book of life, and di kingdom of God dey fo me so I go dey enjoy! Praise Oga Jesus Krist bekos say He safe a poor sina like me. I ask Lord Oga Jesus Krist make he give me grace to see heaven enta. Amen.
