Faith In Oga God
No Mata di Storm Paul (a gospel minister wey dey fo prison) with odas dey fo inside ship and di ship won sink. Nobody sopos comot fo di accident alive bekos of how serious he dey, but God keep all of dem – since bin savants dey involved. Paul talk wetin he face with God on di ship so he go assure oda prisoner of di safety of God. Paul talk say, “ Naw, I won make una heart strong, bikos nobody go die among us, but na only di ship go skata. Bikos yestiday night, God wey I dey serve, En angel appear to mi kon say, ‘Make you nor fear Paul! You must face Caesar and God go safe you and evribody wey dey follow you travel.” (Acts 27:22-24).
LESSON
Any situasens wey come as heavy wind wey dey blow no fit last fo bilivas life, e go later stop. Shalenges fit come, but dem go quick komot. No situation dey difficult fo God, he go ovacome dem patapata. Jehovah get kontrol ova air, land, and sea. All situations dey listen to Am, and dey obey Hin authority. Since christian be di apple of God eyes, we dey sure of safety and viktory all di time. So, we bilivas must dey full of faith and dey sure say God go glorify Hinsef in our lives every time.
PRAYER
Oga God, I understand say I no dey alone, but you dey with me. You go help me overcome all my shalenges, and you go give me viktory. Abeg, give me faith kon make me strong so I go fit dey live a viktorious life fo all di days of my life. Help me so I go fit raise my head above all waters, and let my mouth dey full of viktory songs. Abeg do these fo me and many more. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
