Make We Learn From Di Church Wey Don Dey Before
Di church wey don dey before dey fight well-well on top doctrine yawa; but, Oga God help dem solve am witout wahala. Some brodas dey konfused on cirkumsison mata and dey want make dem explain am to dem. So, dem kol Paul and Barnabas to hear from di eldas wey dey Jerusalem. Di church eldas tok on di mata wit prayer and konklude wit ansa wey konfam. Di eldas talk say kristen wit non – Jewish background most not folow di Jewish tradison by force. He dey konfam say kristen practices mist no dey mistaken for local tradison (or make dem mingle wit am). So, the eldas tell di local churches to dey work in di spirit of freedom, but dey most dey sure say dem no konpromise di holiness standard of oga God. Di skripture tok am say, “Di apostles and di eldas kon whole meetin to tok about di matter. Afta dem don argue well-well about di matter, Pita kon stand up sey, “My brodas, una know sey before-before, na mi God choose make e go prish give Gentile pipol make dem hear and bilive en word. And God, wey know wetin dey inside pipol mind, don show ensef to dem wen E give dem di Holy Spirit, just as E give us and E nor do wayo between wi and dem bikos, E make dia heart klean by faith. So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head? Wi bilive sey God save us thru grace wey kom from Jesus Christ, just as E do for dis Gentile pipol too.” (Acts 15:6-11).
LESSON
Di church wey dey now most know how to settle fight wey di church wey don dey before sabi do. Di church wey dey before deu settle dia fights wit prayer and beta talk. Dem dey receive godly instrucsons from dia eldas, and thru di guidance of di Holy Spirit. No wonda dem dey successful! But, di church wey dey now fit gat di same record of success if dem dey okay spiritually. Our churches most o away from politics, and our most to put spiritual mata based on wetin pipu want or ballot papers. Democracy dey different from Kristenity and wetin dem dey for different. God na spirit, amd kristens most to dey sprirtual! We most to dey pray listen to anytin wey di Holy Spirit talk, so dat we fit make decision wey go satisfy Oga God evri time.If di church dey pray evri time and dey honest in evritin wey dem dey do, Satan go lose hin batu against di churches; and we do dey joli.
PRAYER
Oga God, abeg wake up di church from church from dia deep sleep! Di church don bekom cold, and brodad dom lost dia ability to dey spiritually find yur help for all soluson ova dia problems. Abeg wake our local churches and denominasons again! Help us to dey find yur face so yu go dey guide us for wetin yu want. Let brodas dey take prayer and holiness ova oda tins. Let brodad dey kooperate wit yu, so dat we go fit see signs and wondas like di church wey don dey before. Kon hold our leaders well, save dem from worldly and selfish interest. Let di church and membas prospa on eart, and also dey fit for yur rapsure. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
