God Go Forgive Anybodi Wey Repent
Oga God kip rekod of di Israelites sin, wnd he he ponish dem. Since di pipu no dey fear God and dey ponish dia brodas, Oga God promise to make dem sofa big ponishment. Oga God talk say, “Bikos Israel pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem sell innocent pipol bikos of silva kon sell poor pipol, bikos of ordinary shoe.” (Amos 2:6).
LESSON
Oga God dey kip rekod of sins, and he no go leave sinas wey no repent from ponishments. Di kreator wey sabi all tins go rewod all tins. He go bless pipu wey fear God but go ponish di pipu wey dey heartless and wiked. Notin go eskape Oga God eyes wey he dey use watch witout say he dey do him konfam jodgement. Howeva, Jehovah dey interested to bless sinful pipu dan to ponish dem. He go forgive any sinas wey repent from hin sin. Pesin wey ask say make Oga God forgive am go receive am. But, Oga God mercy ova sinas get limit. He no go wait for a long time make any sinas repent; he go draw line to make him jodgement, and he go porsu all sinas to hell fire.
PRAYER
Oga God, abeg e give me pawa to ovakom di temptason of sin. Help me to dey know my sins and repent from dem. Let me dey receive yur grace to dey remain humble so dat I go get yur mercy and grace in time wey I nid am. Let my joy of salvason last to di end of my life and let me enta heaven wen my journey for dus eart don ova. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
