Oga Jesus Dey Inkomparable
Profet Jonah no obey God and he plan to run away from hin presence, but hin calculason fail am. Jonah wey travel by di sea so he go fit run away from God land insaid di stomach of a fish – and he dey feel di heat wey dey hell dere! Do stobon Jonah repent insaid di fish stomach kon ask for forgiveness. Oga God forgive am kon bring am back to him. Di skripture talk say, “As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God. E sey, “I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi. Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey, so make Yu go kom help mi and hear my prayers. Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.” (Jonah 2:1-3).
LESSON
He dey beta to obey God and receive jin blessin dan to disobey am kon sofa tins wey bad. Oga God get different way wey he dey use korret, and he fit handle him shidren wit iron hand ontil dey kooperate wit him. But, anybodi wey obey God by hinsef go enjoy him benefit dan pesin wey dem force before he obey am. Oga God rate hin shidren wey he like by di wey dem dey obey am He go he go always dey wot di shidren wey he like; he go protect dem and resku dem anytime dem dey insaid yawa, and he go provide for dia nids.
PRAYER
Oga God, abeg make me a shaid wey dey obey yu. Let me dey listen and obey wetin yu talk. Give me di pawa to dey do anitin yu ask me to do. No let me vex yur jodgement wit disobediens. Help me to dey always know say “yu dey see all tims and yu go jodge all tins as dem be – either wit blessin or disciplines”. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
