JESUS DI PROMISE EMMANUEL
God been show prophet Isaiah permanent solution to di problem wey dey go on for the world. For where pipu dey waste time fo God law, prophet Isaiah open wetin God plan, him kon talk say, “Then, God go give una sign by himself: one young woman wey don get belle go born son pikin and him name go bi Immanuel. (Isaiah 7-14)
LESSON
Jesus Krist na di Immanuel wey prophet Isaiah talk say dem go born (Isaiah 7-14) true true, dem born Jesus Krist and dem don find permanent solution to di problem wey dey happen for di world. Through Jesus death and resurrection, e don answer all life question. Pipu who kall
him name and believe am go receive gift of eternal life. So anybodi wey confess Jesus Krist as him aloes and personal savior go inherit eternal life for heaven.
PRAYER
Dear Lord, I believe say Jesus Krist na your only son wey u send to save the world. Na through am i take receive salvation and gift fo eternal life, as another name no dey for under heaven wey fit safe anybodi. I promise to stand with Jesus Krist and i don dey determined to serve am throughout my lifetime. Make God ellep me, Amen.
