Di Rule Of Tithe dey important fo christians
God talk am well-well di importance fo di Israelites make dem dey pay dea tithes as dem dey reach di promise land.
God talk am say, wen you don finish to put am fo one side all di tithe wey be your plenty of di third year and don give am to di levi pipu, di strenjas, dos wey no get papa and mama and wimen wey husband don die so dem go chop fo your side and dey belleful, na den you go con say before una God presence: i don comot di holy tithe comot fo my side, i don comot am give to di levi pipu, di strenjas, dose wey no get papa and mama and women wey no get husband akordin to di kommandment wey you don kommand me, i neva forget your kommandment and i don do everitin wey u kommand (Deut 26:12-13)
LESSON
He dey veri important make everi one weh believe know di first tin wey tithe dey talk about and follow am well-well. God talk am say his children must to bring am di ten percent of di money wey dem see fo di work wey dem do(which we dey call tithe) to provide fo God's word, to meet di minister nid and serve poor pipu. Bilivas must no say Jehovah no dey follow pesin reasin tithe bikos na him get am normal. God don leave am fo us di 90 percent wey remain fo di work wey we do. But even afta he don give us di 90% of di work wey we do, some biliver dey find am hard to give God his own share, them go still keep di 100% fo deap sef, na dem God call mago-mago person (Malachi 3:8-10).
God wey put am down the rule of tithe no go use good eye look any child wey no pay him tithe. Person who no gree pay dea tithe don fail and go sofa fo wetin dem do. Some of d sofa wey dem go see be say dem no go quick get them blessing,dem go loss opportunity. But beliver wey honor God with the money wey dem see for work, wey con bring am without mago-mago go receive blessing wey plenty from him.
Jehovah go dey do person wey dey pay him tithe well so he no go stop to dey pay am.
PRAYER
God abeg help me so i go dey pay my tithe to you, i don know say na di mago-mago wey i dey do no make ur blessing reach me. Abeg forgive me for wetin i don do fo my past, make me start to dey pay all i dey owe you so u go fit dey bless me well-well. Abeg allow make door of better tins open fo me fo evri side and make i get blessing so i go dey bring beta tithe and ofrin join. Make the testimony of your goodness neva comot for my mouth. Na for Jesus name i beg for all this. Amen.