DISCOVER JESUS KOMBAT STYLE TO PREVAIL OVER SATAN
Di Farisi nor dey for Jesus krist, dem dey hide under dea religion to take express di jealousi and pepper bodi wey dem bin get for ham. Dem dey follow ham go every corner just to dey find excuse wey dem go take criticize and distroi him ministry. Di scripture talk about some tins wey dis Farisi do. Jesus dey waka pas wea dem plant corn put and him disaipoint kon plok som corn dey chop. Som of di Farisi pipol kon sey, "Why una dey du wetin awa law talk sey make wi nor du for Sabat Day?" Jesus ansa dem, "Una neva read wetin David du wen en and en men dey hungri?” E enta God haus kon tak di bread wey holi wey only prists sopoz chop and en and en men chop am. So Jesus kon tel dem, "Na Man Pikin bi Sabat Oga." For anoda Sabat day, Jesus enta di sinagog dey tish. Won man wey en right hand don die dey dea. Di law tishas and di Farisi pipu dey luk Jesus wit kona eye weda e go heal pipu fo Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akiuz am. (Luke 6:6-7) (Luke 6:1-2)
LESSON
Satan love to dey plant him Evil agent near godly pipu to take frustrate dea egg effort. Di enemies go make sure say believers do wetin dem no suppose do, so to take overcome devil, believers must to dey spiritually sensitive, dem must sabi pray wella and then dey filled with Holly spirit. Make believers no forget say no bi to discourage dem make dem no fit to dey serve God na him dey him mind only, him main plan na to kill, to tif and to destroy dea salvation (John 10:10) So wen we (believers) continue to dey prayerful and watchful. We fit dey follow Jesus example;
*Jesus been ignore di Farisi - make we believers ignore wetin dem go dey do to us
*Jesus no stop to dey do God business - make believers no stop to dey do wetin God tell us
*Jesus go waka go where dey quiet to take pray for strength to take continue him ministering - believers must refill and refresh their energy through prayer
*Jesus been dey change location to take avoid him enemies - believers suppose to different area for ministry to take confuse their enemies.
PRAYER:
Dear God, i beg give me strength to overcome Satan and live triumphantly on earth to di glorification of your holy name! Again, give me strength to remain focus and pay no attention to devil and hin evil agents! Let yo Holy Spirit empower me to remain immovable, and to keep faithfully serving you during opposition and challenge. Also, let yo Holy Spirit empower me to dey watchful and prayerful so dat I fit keep prospering in all my ministerial activity, so dat light of yo gospel fit spread throughout di world. Wen my earthly race eventually over, let me appear in your presence fo heaven to hear "Weldon and welcome my servant to di joy of yo Lord!" Fo I make my request in Oga Jesus krist name. Amen.
