Impotans Wey Dey To Preach Di Gospel
Oga Jesus Krist no eat bekos he won preach di gospel. He use any chance wey he get to preach di gospel as sumtin wey get value, and he use am to bring pipu to di kindom of God. Wen hin pikin wey dey folow am tell am say make He eat, He tell dem say, “I get food wey I go chop wey una nor know about.” Di disciple kon dey ask demsef, “Abi somebody don bring something fo am to chop wen we nor dey here?” Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa talk and make I finish di work wey E send me.” (John 4:32-34).
LESSON
Children of God suppose dey set dea mind say dem won satisfy God every time, no mata wetin go happen. We must dey learn from our master Oga Jesus Krist wey neva trade hin ministry fo anything. He even no chop so he go fit preach di gospel (John 4:32-34): he no even dey rest bekos say he won preach di gospel. Time no wait fo any pesin, and every child of God must see every moment as di beta time to dey preach di gospel. Beta time no fit dey to dey preach di gospel; so, we must use every opportunity weh we see preach di gospel! Every christian must to preach di good news of Oga Jesus Krist to all pipu – whether di time dey konvienent or he no dey konvienent! Di skripture talk am di need to dey preach di gospel (2 Timothy 4:1-5). Oga God keep hin plenty blessing fo any pesin wey preach krist gospel to odas karefully.
PRAYER
Oga God, abeg give me pawa to dey preach di gospel every time – whether he dey konvienent or not. Help me to dey understand di reason why evangelism dey koko, and make me dey preach di gospel di way you want am. Come anoint me with your grace to dey explain di gospel in a way wey go bring positive reward to your kingdom. As I dey share di gospel, let di unbeliever dey submit dea faith to Oga Jesus Krist and dey safe. In addition, abeg bless me, and make me dey receive di reward wey suppose dey bekos I obey wetin u talk. Na fo Oga Jesus Krist name i beg all this. Amen.
