Oga God Be Sovereign
David’s best friend (Ahithophel) leave am, kon want make he die by all means so he go dey promoted by Absalom. Ahithophel sabi David well-well; he be hin padi for many years. He know where David pawa and weakness dey, and he dey redi to sell dia friendship so he go get beta post wit Absalom wey komot hin fada from di throne. On di oda hand, David know well-well di yawa wey surround am. So, he kry to Oga God for help. David ask God say make he skata Ahithophel’ kounsels – and na dat tin Oga God do! Ahithophel’s kounsels no kon dey impotant to Absalom and he dey disgraced. Di traitor vex to di extent say he kill hinsef. Gow amazing Oga God help David wey no get any pawa to joli ova hin diffikult time!
Lesson
Evil pipol no fit show dia pawa foreva, Oga God go deal wit den! Since God get di pawa to arrest anybodi, he go surely arrest and rewod di wiked pipu akordinly. On di oda hand, shidren of God wey dey face many shalenges most to take heart; Oga God go fight for dem, and he go defend dem as dem want. Howeva, shidren of God most to put dia trust in God. We most no dey put all our trust for any man or wiman, it most be in God. Man fit fuck up but God no fit fuck up! Man no dey perfect, but God dey perfect. If man fuck us up, Oga God no fit fuck us up!
Prayer
Oga God, abeg teach me how to dey trust yu ova all cirkumstansis of life. No let me put all my trust for human being wey fit fall my hand. Let me dey put my 100% trust in yu evri tym. Also, let me remain konfident say yu go dey defend my interest- even wen I no dey dere. Yu go dey sure say I dey safe, and yu no go allow di enemis to share yur glory wey dey my life. Bekos sat I don pray by faith in di name of Oga Jesus Krist yur son. Amen.
