God Dey Ansa Prayers
Absalom komot hin papa King David, kon dey plan to kill am. King David wey don lost hope dey waka for di wilderness and he no know wetin he wan do. For dat time wey he dey worried, David kry for hin prayer to Oga God. Di skripture tok am say, "David kon go Mount Olives bigin kry. E nor wear any shoe and e kover en head to show how e nor dey happy. All di pipol wey follow am still kover dia head as dem dey kry.” (2 Samuel 15:30).
Lesson
Shidren of God sopos turn to Oga God through prayer wheneva dem dey inside wahala. Dis world dey of positive and negative situeasans; So, Kristen most to dey pray to ovacome dem. Since Oga God love hin pipu, he go ansa dia prayer. He no go leave hin own pipu inside wahala. God go ansa hin pikin wen dem kry to am, and go make dia face dey shine no mata any diffikult situesan wey fit come dia way.
Prayer
Oga God, abeg dey teach me how to dey pray to yu for help wen tins no dey go well. Wen i dey pray, abeg dey listen. Dey ansa my prayers kin dey do evritin wey i ask yu from my heart. Let me dey live in joy, peace, and prosperity for all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name i beg all dis. Amen.
