Dey open ear to di holy spirit, collect your blessing
Oga God talk say make di Israelites use some sense to win di jerico city. Dem march round di walls of jerico wey get power fo six days, dem go kon blow dea ram horn sound kon dey shout join fo di seventh day. Oga God talk am fo Joshua wey bi di Israelites oga say "God kon tell Joshua, “Si, I won distroy Jeriko fo una, plus di king and en sojas,make una sojas match round di town ones and make una do like dat fo six days,make you tell seven priests make dem karry seven ram horn for di box front, den fo di sevent day, make una match round di town seven times, while di priests go dey blow di trumpet.Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shout fo war and di town wall go fall rish grand, den una go attack am.”(Joshua 6:2-5). Di Israelites kon do di tin wey oga God tel dem and hin work well-well. Di walls wey dey jerico fall down, dem kon win dose wey dey inside dea"Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shout well-well fo war. Di town wall fall reach grand and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipu, dem use dea swod take kill every thing wey dey breath fo di town, both man and woman, small pikin and old pipu, plus all di animals.(Joshua 6:20-21).
LESSON
Oga God get sense well-well, na so hin dey use hin sense take bless hin pikin, na so hin do fo di bible, Jehovah fit tell hin pikin make dem do sumtin wey no get sense and dem go still get dea blessing.
But, oga God pikin most to get sense fo di spirit so dem go dey chop from oga God blessing. Believer must get sense fo di holy spirit so dem go understand oga God mind if no bi so dem go do wetin wrong or no do anything at all. If believer won get sense fo holy spirit, hin need to dey pray well-well, make hin kon dey read di bible join. A believer wey wan work under God leadership must live a beta life, he bin to follow wetin God talk(on top anything even if na small or big mata). Di more pesin dey follow di holy spirit, di more hin go dey follow wetin di holy spirit tel am and hin go dey enjoy.
PRAYER
God abeg, kon help me dey get sense to dey follow di holy spirit fo my life. Kon help me to carry my life give you, make i dey follow wetin you talk fo all my life, so i go dey enjoy, kon dey enjoy your plenti blessin fo my life. Na fo oga Jesus Christ name i beg fo all dis. AMEN
