A kristen must dey discipline
Oga Jesus krist talk am say di need wey we need to get godly and spiritual discipline because na him we go take reach oga God kingdom. Oga Jesus talk say"So Jesus tel all of dem, “If pesin won follow mi, e must forget himself, karry en kross everyday, dey follow mi,bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi, go save am.Wetin pesin go gain if e get di whole world, but e luz en soul? Anybody wey dey shame for mi and my word, Man Pikin go shame for am wen e go kom back for en glory and di glory wey en Papa and di angels get. (Luke 9:23-26).
LESSON
Ani pesin wey dey call hinsef ogbonge Kristen most to dey disiplin, make hin con folow wetin oga Jesus tok wey dey down laidis:
1. Ogbonge Kristen most to dey kanpe wit God evri dae"So Jesus tell all of dem, “If pesin won follow mi, e must forget ensef, karry en cross evriday, dey follow mi. (Luke 9:23).
2. Ogbonge Kristen most to dey proud of di gospel and dey tok about am to all di pipol" Bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi, go save am. (Luke 9:24).
3. Ogbonge Kristen most to dey tok wetin be confam evri time"Wetin pesin go gain if e get di whole world, but e luz en soul? (Luke 9:25).
4. Ogbonge Kristen most to know and dey sopot wetin bible tok even if hin culture no dey sopot am" Anybody wey dey shame for mi and my word, Man Pikin go shame for am wen e go kom back for en glory and di glory wey en Papa and di angels get. (Luke 9:26).
PRAYER
Oga God abeg, con help me to be a beta Kristen wey dey do am well-well for goodly work, con make me a dead pesin to di flesh and oda tin wey no good. Con help me fight a beta faith fight as you tok am so i fit dey kanpe for your kindom. Na for Oga Jesus Christ name i beg all dis. AMEN
