Using di power wey oga Jesus give us
Oga Jesus Christ tell him pikin wey dey follow am to dey preach di gospel , he kon back dea work wit beta sign and wonder.
The skripture talk am say "Afta Jesus don koll di twelf disciples togeda, e give dem power and authority to drive demon and to heal pipu wey nor well. Den e kon send dem go prish about God Kingdom and heal pipu wey nor well. E tell dem, “Make una nor take walkin stik, bag, bread, money or estra klot follow body".(Luke 9:1-3).
LESSON
Oga Jesus krist na di only pesin wey dey wey get power wey pass every pesin power to bind and lose any time wey him like. God don carry him power give eni pesin wey go need am to win anytime. The skripture talk am about Oga Jesus say"Because of dis, God raise am up
kon gi-am di name wey big pass every oda name, so dat wen dem kol Jesus name,
everybody and every thing must knee down, weda dem dey heaven, eart or fo under di eart and every tongue go konfess say, “Na Jesus krist bi di Oga God,den all di glory go bi God own". (Philippians 2:9-11).
Oga Jesus kon choose say hin no go kip di power fo hinself only but he talk say hin go share am with him pikin wey dey follow am. So, ani pesin wey talk am say hin get faith in oga Jesus Christ go get big pawa wey be for oga Jesus Christ to joli for evri time of hin life. Oga Jesus tok am to his pikin wey dey follow am say"I tell una true word, anytin wey una take prayer tie for eart, God go tie am for heaven and anytin wey una take prayer luz for eart, God go luz am for heaven,again, I tell una true word, if two of una for dis world gri and pray for anytin, my Papa for heaven go do am for una. Anywhere two or three pipol gada for my name, I go dey der with dem.” (Matthew 18:18-19).
PRAYER
Oga Jesus krist, you bi wonderful son of God, you kon get some power to do anything you won do. I know say you give am to your pikin wey dey follow you di same power. Now, i bi Kristen, your pikin wey dey follow u, i kon chop from your power and i don talk to use am well-well. To di glory of God, i go use di power of oga Jesus name to talk di gospel and i go use am to work good tins wey go suprise pipu. I no say na my head good pass fo dis eart since i don bi oga Jesus krist pikin.,Yes, i don bi champion in di faith of God, and my enjoyment go stay forever. AMEN
