Oga God Hates Sin
Di skripture tok am on how di Israelites plan against Oga God.
“Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga dia God; di Pesin wey save dem from Egypt pipol and King Fero hand. Dem dey woship oda gods; di kountries wey God porshu bikos of Israel pipol, dem dey follow dem serve dia juju kon dey do all di bad-bad tins wey Israel kings do before. Israel pipol do some bad tins and di Oga dia God nor like am. Dem build juju house for all dia towns; from di towa wey di men from dey wosh go rish di town wey dem guide well-well. Dem build image and Asherah juju for evry high place and under evry green tree. Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.” (2 Kings 17:7-11).
Becoz of di sin wey di Israelites komit, Oga God allow make di enemies kapture dem to anoda land. Di king of Assyrian invite pipu of oda kountries to dey live in di land of Isreal. “Instead of Israel pipol, Assyria king kon pak strenjas from Babilon, Kutah, Avva, Hamat and Sefarvaim go stay for Samaria towns.” (2 Kings 17:24).
LESSON:
Oga God dey patient, loving and forgiving; but he fit vex for sinas wey no wan repent. Di kreator fit decide to comot hin protesan from any of hin pikin wey no gree comot from hin wikedness. On di oda hand, di enemis fit use dat chance to attack! So, all shidren of God most to work hard to satisfy Oga God evri time, so dat dem go enjoy hin divine protesan. Creator can decide to remove his protection from any of his children that refuse to repent from his/her wickedness. Meanwhile, the enemies can easily seize the opportunity to attack! Therefore, all children of God must strive hard to satisfy God at all times, so that they can enjoy his divine protections.
PRAYER:
Oga God, abeg no let me vex you. Instead say make I vex yu, let me live life wey dey holy so dat you go dey hapi wit me, and so dat you go bless me. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
