A Leda Must Honor Oga God
Di skripture konnect many Israelites’ ledas to King Jeroboam. Who be Jeroboam? He bin Israelites king wey wiked,wey komit many krimes, wey kause di Israelites not to dey woship di living God. Jeroboam no follow wetin God tell am, he kon dey woship idol. He also plan different style to dey woship idol. (Some of di idol ask pipu do dey sakrifice dia shidren for woship). Oga God ponish Jeroboam for all evil tins wey he do; but no be evritin be dat. History no forgive Jeroboam for hin evil works! Evri evil king wey reign afta Jeroboam dey konnected to dey evil plan of Jeroboam. Infact, we go still read about di evil tins wey Jeroboam do for di bible today. Small example of di evil pipu wet reign afta Jeroboam be dis:
-
King Zechariah “For thirty-eight years wen King Zabud dey rule Judah, Jeroboam pikin, Zekaraya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for six mont. E nor gri obey God, just as en grand-grand papa dem do. E kontinue to do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.” (2 Kings 15:8-9).
-
King Menahem“For thirty-nine years wey Zabud bi king for Judah, Gadi pikin, Menahem kon bi king for Israel. E rule from Samaria for twelf years. E nor gri obey God; e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.” (2 Kings 15:17-18).
-
King Pekahiah“For fifty years wen King Zabud dey rule for Judah, Menahem pikin, Pekahaya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for two years. E nor gri obey God kommand; e kontinue to do like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.” (2 Kings 15:23-24).
-
King Pekah“For fifty-two years wey King Zabud dey rule Judah, Remalaya pikin, Pekah kon bi king for Israel. E nor gri obey God; e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.” (2 Kings 15:27-28).
LESSON:
Every leda (of any kapacity) most to dey kareful not to abuse hin posison. Husband most be a good example; wife most dey god-fearing, and siblings most to dey be a good example for each oda. Also, a leda of any kapacity (whether na captain, group leda, team leda, mentor, pastor, senator, governor, president, or any oda) must to dey use hin rightful posison well-well. He/she most to lead wit di fear of Oga God! Howeva, we ondastand say humans fit fall anytime, and we fit make mistake. We most to dey repent from mistakes once we don know dem, and we most to do korreson wey dey impotant. Shaid of Oga God most to ondastand say he dey impotant to get di spirit wey dey teash and wey dey respond to di korreson of Oga God ova anitin bad tin wey we do. Di kreator go bless pipu wey show good attitude to anytin wey he talk. But, our fada wey dey heaven dey vex for shidren wey storbon. He go ponish shaid wey no dey obey am if di pesin no gree change. Also, the fact say history no dey forgive bad pipu most to dey ring for our heart!
PRAYER:
Oga God, abeg help me to dey show good behavior if I dey receive korreson. Kon give me dey teashable, humble spirit. Kip me honest, and help me to admit my mistakes. Help me to dey make good step so I go dey improve, help me to be kristen wey dey grow, wey dey put holiness, honest, and integrity ova oda tins. Abeg do dese for me and many more for me! Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
