You no Serve God And Mammon
Oga Jesus krist warn hin pikin wey de folow am say make no get hand fo mago-mago rishes, but make dem ask fo good wealth wey go glorify God. Oga Jesus krist talk say"Anybody wey fit handle small tins, go fit handle big tins too and anybody wey do wayo fo small tins, go still do wayo fo big won too. If pipu nor trust you with money fo dis world, God nor go fit give you en rishis fo heaven. And if pipu nor fit trust you wit dea property, na who go give you your own?
“No savant go fit serve two oga, bikos e must hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en body dan di oda one. So, you nor go fit serve God and money fo di same time.” (Luke 16:10-13).
LESSON
If we dey porsu rishis wey clean, dat won no be evil, but if wey dey porsu rishis wey no clean, na dat one bi real evil. Kristen no sopos dey porsu rishis wey no holy. As shidren of God, we must dey sheck our ambitions, and we must see say we no do wetin God no want. He dey impotant make we know say God dey see everitin wey we dey do and he do reward fo dis life and fo heaven also.
PRAYER
O my God I wan dey rish, but I no wan go to hell fire! Kon help mi porsu rishis wey clean and help mi so i do dey honor you wit anytin wey i get. Kon help mi so i go use my rishis to serve you and help oda pipu. I no wan dey punished, but make i get my rewod fo di eart and fo heaven also. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
