Joy dey fo heaven ova a sinner wey repent
Oga Jesus krist preached on forgiveness and he talk di stori of prodigal son to sopot hin sermon. Di prodigal son inherited hin fada while he still dey alive. He distob him fada ontil hin fada give am hin inheritance. But, di boy carry all hin rishes go foreign land wea he spend am finish fo small time. Howeva, he kon know say he don do mistake, kon go back home. He tel hin fada make he forgive am, and hin fada ansa am well, hin fada talk say;
“But di papa koll en savants kon tel dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem fo my pikin. Den, make una go take di melu wey fat pass, kill-am make wi do party, bikos dis my pikin die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, I don si am!’ So di party kon start.” (Luke 15:22-24).
LESSON
God go accept well-well eni sinner wey komot fo hin sin kon come back to him. Even sef, both God and hin angels go wear dea dancing shoes and dem go joli fo di fellow. Oga Jesus talk say "I tell una true word, na so happiness dey fo heaven wen one sina turn from sin kom meet God, pass ninty-nine good pipu wey don already dey wit God.” (Luke 15:7).
PRAYER
God abeg, i know say you love sinnas but you hate dea sins, now, i don talk say i go leave my sins kon come to you. I dey sori fo all di bad wey i don do before, and i don leave dem. From now on, i go serve you wit all my heart and all my pawa. I go do my best to obey anitin wey you tel me. Write my name fo di book of life and make mi dey fo dose wey go enta your kindom. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
