Wisdom weh Dey Outstanding Through God Word
Exceptional wisdom na guarante for pipu wer duly study God's word. One psalmist talk say,
“I getmore understanding pass all my teachers, for your testimony be my meditation. I understand pass dem ancient, because say I keep your precepts” (Psalm 119:99-100).
LESSON:
Di person who study God's word daily no go regret he decision. Di word of God lead to inspire and divine wisdom were go make person dey wiser and stronger. Therefore, all dem children of God dey encourage to study dem bible always, so that den go fit enjoy God's goodness and radiate for him glory.
PRAYER:
Dear baba God, abeg enable me to study your word daily. Empower me to comply with your instruction so that I go fit prosper and enjoy your goodness wer dey di land of the living. For in the name of Jesus krist an him I make my request. Amen.
