Signs Of Di Second Coming Of Oga Jesus Krist
Di second coming of di Lord Jesus krist go occur as if someone dey get daydreaming. E go be sudden and many pipu go caught unaware. Di Bible talk am say,
“For you yourselves know perfectly say the day of the Lord go come as a thief in di night. For when dey say, “Peace and safety!” Then sudden destruction come upon dem, as labor pain dey upon pregnant woman. And dey no go fit escape” (1 Thess. 5:2-3).
LESSON:
Jesus krist no go send prior notice to anyone before him appear in the sky to con take him own pipu home. We don get enough awareness about rapture and di thing we go happen after am. Jesus krist go carry him pipu to heaven, but dem unbeliever do dey abandon for earth and so devil go torment dem. The bad thing b say, , God go cast devil and all him victim to everlasting fire – hell fire. Therefore, all pipu should dey sensitive to current world event wer dey show us say E don reach the time wer di world go end. All dem pipu should take proactive step to become children of God. We must confess Jesus krrist as our Lord and savior.
PRAYER:
Dear Jesus krist, I dey aware that you go appear any moment from now to rapture the saint to heaven, and I want dey rapture also. Therefore, I repent from my sin and I confess you Jesus krist as my Lord and Savior. I go dey faith to serve you from now; abeg write my name for di book of life and make I remain rapture-able to heaven. For in the name of Jesus krist na him I make my
request. Amen.
