Who Takes Di Glori?
Stephen reminded di Jewish pipu say God sent Hin Son Oga Jesus Krist to safe di world, so wetin di old testament bible tok go come to pass later. “Na dis Moses tell Israel pipu sey, ‘Na from among una God promise sey, E go raiz-up one profet wey go lead una.” (Acts 7:37).
LESSON
Di kol of God upon Moses to safe di Israelites from dea Egyptians bondage get effet in di bible (Exodus 3). Moses become di deliverer of hin pipu. Wit di help of God, he struggled and win against King Pharaoh and oda Egyptians. Oda di oda hand, Moses freedom adventure na sign; it represent Oga Jesus freedom wey go show afta some years. Moses physically free di Israelite, but Oga Jesus go come free di Israelites and all di world. Di freedom wey dey see through Moses no fit safe dea sins, but di freedom wey Oga Jesus go give Hin pipu go deliva dem patapata from dea sins. Oga Jesus Krist come to fulfill hin mission; So, he still be di supreme deliverer of all time. Through Oga Jesus death and Hin resurrection, He show big pawa to safe pipu from dea sins and di pawa of hell fire.
PRAYER
Glory to God fo Oga Jesus Krist don bring permanent deliverance fo HIn pipu! I don tok am say I go dey serve Oga Jesus bekos He don die fo my sins con wake up to give me life wey no dey finish.Since I don be shaid of God, sin, death, and hell no get pawa ova me anymore. Glory to God, Hallelujah!
