God Be Love
Oga Jesus Krist established a rule weh be say Hin pikin wey dey folow am must to dey love one anoda well-well, and evri kristen must to dey folow Hin rule. Oga Jesus tok am say, “I dey give una new kommand: Una must love each oda, as I love una, so dat evribody go know sey, una bi my disciples if una love each oda.” (John 13:34-35).
LESSON
Love na God law, and all kristens must to dey apply am. In fact, nothing dey important to God dan love. He send Hin only Son Oga Jesus Krist make he come die fo di world bekos of love (John 3:16). Oga Jesus Hinsef tok am say He get konfam love fo Hin pikin wey dey folow am. He tok am say, “Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die fo di sheep.” (John 3:16). On di oda hand, Oga Jesus tok am say all Hin folowas must to dey show love to one anoda (John 13:34-35). So, anyone wey tok say dem be Kristen but no get love neva ondastand his or her konfeson. Kristenity means love, and evri Kristen must to dey show love to kolet God blessin on eart and in heaven.
PRAYER
In the name of Oga Jesus Krist, I pray fo felow kristens and myself say make God give us di spirit of love. May di Almighty God give us pawa to love each oda! Make di church stop dey separate demsef so dem go love and serve God wit di spirit of unity! May pride, stubbornness, and self righteous spirit be ovacome in Kristen fold! May all shidren of God feel and experience konfam love of God wey dey beyond wetin human fit tok! Make he dey well of all belivas in Krist today, tomorrow, and forevamore! Amen.
