We Should Bear Good Fruits
Oga Jesus Krist tell hin folowas tobdey preach di gospel and get fruits fo di kindom of God; any pesin wey no get any fruit no go get rewod fo heaven, but di pesin go dey kondemned. Oga Jesus tok say, “Na mi bi di korrect vine and na my Papa bi di gardina. E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit fo my body komot and E dey ripair evry branch fo my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit.” (John 15:1-2).
LESSON
As far as oga Jesus dey dere, excuse no dey fo any kristen wey no get fruit fo heaven. Evri kristen must to bring rewod wey no get mago-mago fo heaven. Di folowas of Oga Jesus Krist must get kourage to face and ovacome anitin wey shalenge dea faith. No kristen must to allow oppression ovacome am, since he/she must to preach di gospel. To dey preach di gospel dey koko, na God tok am, and evri kristen must to do am. Di bible tok am say, “I dey tell you wetin to do fo God and Jesus Krist present. Wen Krist go appear to make En kingdom stand, E go judge pipu wey dey alive and doz wey don die. Make you dey prish God word and dey ready, weda di time dey okay or not. Make you use patient take korrect and enkourage your pipu with betta tishing. Bikos time dey kom wen pipu nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear. Dem go rijet di trut and love lie-lie story. But make you kontrol yorsef fo evritin. Nor fear to sofa fo Krist. Dey do God work and dey tell odas about di Good News.” (2 Timothy 4:1-5).
PRAYER
Oga Jesus Krist, abeg help me to remain kanpe in your service. Help me to dey preach di gospel and bring fruits to your kindom. Give me grace wey I go use endure all persecution, and give me pawa through di Holy Spirit to stop excuses and dey serve you well-well. Anoint and give me grace to be an instrument wey you go use comot pipol from Satan kindom con bring dem to yur kindom. Help me so I go serve yu well on eart and dey qualified for yur plenti rewods wey dey heaven. Na for Oga Jesus Christ name I beg all dis. Amen.
