God Dey Merciful
God dey kind; he dey merciful, and he dey forgives sins. Di sheck God’s kindness, con tok say, “As di sky high from di eart, na so too en love for pipu wey dey fear and serve am, big rish. Just as east far from west, na so too E make awa sins far from us. Just as papa dey love and pity for En shidren, na so too, God dey good and dey sorry fo doz wey dey fear Am.” (Psalm 103:11-13).
LESSON
God be di most pawaful pesin wey dey exist and He fit do anything weh go please am. Even say He get konfam pawa wey He fit use punish sinas, He don tok sey He go show mercy and forgive any pesin wey dey humble enough to say “sorri”. God go forgive and bring bak any sinas wey beg fo mercy; He go also give di pesin pawa to pursue righteousness. How amazing he dey to diskova say God no go quick judge sinas? Instead, He go show Hin love towards dem, and give dem opportunity to repent. Jehovah go open Hin arms well-well to receive sinas wey repent, and He go forgive dem dea sins. Moreova, God no go forgive any sinas without sakrifice, and Oga Jesus Krist don make di sakrifice! Now, any sinas wey repent kon show hin faith in Oga Jesus Krist – as true Son of God – go receive forgiveness of sin and dey safe. Di felow go also receive life wey nor dey finish fo heaven.
PRAYER
God abeg, I dey sorri fo all my sins, and I repent from dem all. I give you my life today, kon konfes my faith in your Son Oga Jesus Krist wey be Lord. I bilive say Oga Jesus die kon wake up to give me life wey nor dey finish; I konfes my faith in Am, and I accept Am as my personal Lord and Savior. I promise to dey faithfully serve Oga Jesus Krist fo all di days of my life. Amen.
