We Must Bear Fruit
Paul mission na to preach di gospel of Oga Jesus Krist to all di world. Hin primary goal na to reach di far land wey pipu never hear di gospel. Paul talk wetin Isaiah don talk before (Isaya 52:15). Just as God word say, “Doze wey dem tell about am, go see am and dose wey never hear about am, dem go understand.” (Romans 15:21).
LESSON
Paul na true follower of Oga Jesus Krist wey dey go everywhere to talk about hin master. Fo gospel sake, Paul dey escape as dey won kill am; he risk hin life everyday by say he dey preach di gospel to pipu wey no won hear. Even say he face many challenges, Paul di servant of God no dey tire to dey preach di gospel and hin effort later pay am. As Paul dey change how he dey preach, di gospel reach di Asians, Greece, and Roman Empires. In fact, Paul letter wey hin write to di gentiles become di significant part of di bible. Since Paul be human being and fellow christian as we be, we fit get courage to do great things fo di kingdom of God. We must to dey preach di gospel of Oga Jesus Krist to everyone wey dey around us and to di world. All christians – without say we komot any pesin – must understand say our primary assignment na to preach di gospel to di world. God go later reward every christian base on how dem obey hin commandment – preaching di gospel!
PRAYER
Oga God, I no won be a fruitless child, I won dey fruitful fo your kingdom. Abeg help me put evangelism above other christian assignment. Give me pawa to talk about Oga Jesus Krist to my neighbour, my friends, and family. Kon help me to dey support and dey part of your effort – from my church and other evangelistic ministries – so that land wey dey far away go hear di gospel of Oga Jesus Krist. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
