Di Konfam Life
Oga God talk am say di Israelites dey play double game with Am; He talk say di Israelites – Hin children – enjoy Hin benefit to dey big, kon leave am later. Israelites collect di benefit of God kon return to dey worship idol. Di creator promise to punish di Israelites fo dea action. God talk say, “Before-before, wen Efraim pipu dey talk, di oda tribes fo Israel dey fear and respect dem. But naw, Efraim pipu dey worship Baal juju and this thing kon distroy dem. Dem still dey sin and worship juju wey dem make kon design am with silver. Dem dey sey, “Make una come sacrifice and kiss dis juju!” So just as dew dey vanish fo morning, na so dis pipu go disappear too. Dem go-go like leaf wey breeze blow or smoke wey dey fade. God sey, “Na Me be di Oga una God wey take una komot from Egypt. Una nor get anoda God apart from me. Na me dey safe una. Wen una dey dry land wey nor get anything, na me take care of una. But now weh una enter better land, una don dey okay; dey karry body up kon forget me. So, I go attack una like lion. I go hide fo bush dey wait una like leopard. I go attack una like bear wey en pikin lost kon tear una to pieces. As lion and wicked animals dey destroy things, Na so too I go destroy una.” (Hosea 13:1-8).
LESSON
Children of God no dey allow to play double game with him. We no dey allowed to collect di creator benefit make we kon turn our back to am. We no dey allowed to do mago-mago with God but we must to serve am with our heart wey dey honest. We must dey kanpe with God, and dey thank am with our service wey dey acceptable. Make we no be pesin wey no dey appreciate after we don get hin benefit. God talk say make we dey run fo sin and dey follow Hin path of righteousness so we go fit prosper. Oga God dey ask say all pipu must believe Hin Son Oga Jesus Krist as di only Savior of di world wey get di key to heaven. Anybody wey obey di law of God wey kon dey serve Him well-well go prosper fo sure.
PRAYER
Oga God, I won dey live a straight forward lifestyle before you. Abeg help me dey consistent with you in everything wey i dey do. Let me dey plain and truthful before you. Make you give me pawa to dey thank you fo your goodness fo my life, make me dey live di best of life to dey glorify your holy name. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
