There Is Reward In Heaven For Steadfastness
Kristians church go be persecuted prior to di second coming of Jesus Krist. Some believers go lose dea lives to di persecutions, but di horrifying event go only happen fo a limited time - and nothing go go uncounted fo. Krist go rescue Hin saints, and those weh die fo di sake of Hin name go resurrect to experience eternal life with Am. John describe his revelation, “Then I dem give me a measuring stick, and I dem tell me, “Go measure God Temple and the altar, and kount di worshipers numbers. But make you no measure di outer kourtyard, becuase e don dey turn over to di nations. Dem go trample di holy city fo 42 months.” (Revelation 11:1-2).
LESSON
God pikin go suffer persecution and oppression fo earth fo di sake of dea faith in Jesus Krist, but dem go reap rewards of dea faith fo heaven. Krist go wipe tears komot, dea face; He go decorate dem with beauty and honor. Krist believers weh remain steadfast with unshifted faith no go only receive special treatments from God, but dem go also receive di gift of eternal life. God go crown dem, and dem go be Hin princes and princesses. Hence, di price of steadfast kristianity!
PRAYER
Dear God, i beg grant me grace and power to faithfully serve you throughout di days of my life. Help me to remain immovable during adversity; make me remain konfident with di testimony of the Lord Jesus Krist, and proclaim undeniable faith weh go glorify your name. I beg make your Holy Spirit give me pawa to remain fit fo di second koming of Jesus Krist. Make me remain rapturable! Fo in your Son Jesus Krist i make my requests. Amen.
