No One Is Irreplaceable
Queen Vashti dishonor her husband King Ahasuerus fo di presence of dignitaries and ran into trouble. The queen turned down her husband request to dance and showcase her beauty; she insult Am to mind hin business as she mind her. For dis reason, di ruling cabinet dethrons her and sort fo a better replacement. E dey fo record, “On di seventh day, wen king heart dey merry with wine, he kommand Mehuman, Biztha, Harbona, Bigtha, Abagtha, Zethar, and karcas, seven eunuchs weh serve fo di presence of King Ahasuerus, to bring Queen Vashti before di king, wearing her royal crown, fo her to show her beauty to di pipu and di officials, fo she dey beautiful to behold. But Queen Vashti refuse to come fo di king kommand bring by his eunuchs; fo dis reason di king vex well well, and hin anger burn within am” (Esther 1:10-12).
LESSON
Pride go before pesin fall! All kristians must dey humble before God fo all times. We must no dey obsessed with positions and pawa. We must yield to korrections. We God pikin must not forget sey we dey replaceable. Di Kreator get plenty options, and He fit easily replace anyone position. Fo dis reason, all pipu must tremble before God, and we must no allow pride to cause us to sin against Am.
PRAYER
Dear God, i beg teach me how to dey humble before you. Make me yield to your instructions and korrections so that i fit experience your promotions. I beg save me from pride – since e go lead to destruction! Instead, make me give room fo leadership of your Holy Spirit so that i fit live a victorious life on earth and enjoy your goodness fo di land of di living. Fo in Oga Jesus Krist i make my requests. Amen.
